Chelsea don waka jejely enta FA Cup nes round as de London team beat Derby County 2-0 for dia FA Cup third round match as Nottingham Forest don pack enuff gbege on top manaja Sam Allardyce as dem carri hin West Ham team do yeye waya dem 5-0.
Naija pikin John Mikel Obi, wey bin dey play hin numba 300 match for Chelsea and na him sef be kaptin for de match fes score for de blues for de secon haf for 66 minut.
Brazil midfielder Oscar come setul de matter for de 71 minute afta hin kollect beta pass from Hazard bifor hin shoot am pass kipa Derby kipa Lee Grant enta net.
Torres sef for kuku add anoda one but afta him beat kipa, ball come jam for hin leg and Ramires sef bin hit post later later.
West Ham don become de secon Premier League team to pak dia load waka as team wey dey below dem push dem comot from de competition.
Nottingham Forest kipa Jamie Paterson hama beta hattrick for de match inside 14 minutes sef, plus Djamel Abdoun pena and Andy Reid gol take complit de market for Forest dem.
West Ham manaja Sam Allardyce bin change nine players for his starting team plus hin put three smallies make dem kuku play dia fes match.
"Me no get choice for de matter oh! Wetin I fit do again.
"I bin do am like dat make I take rest some playas becos we get playa problem."
Sunderland beat Carlisle United 3-1 for Stadium of Light to waka enta round four.
Adam Johnson na im open market for dem for de 34 minute wit beta freekik plus hin come arrange beta cross wey Sean O'Hanlon take push enta hin own net afta Matty Robson bin ekwalise for Carlisle.
France midfielder El-Hadji Ba come complit all de market score de numba three gol to jolly manaja Gus Poyet belle.
Na Sunday FA Cup results be dis:
Nottingham Forest 5 West Ham United 0
Sunderland 3 Carlisle United 0
Derby Country 0 Chelsea 2
Liverpool 2 Oldham Athletic 0
Port Vale 2 Plymouth Argyle 2
Source : http://www.supersport.com/football/nigeria-naija/news/140106/Chelsea_waka_FA_Cup_enta_ness_round
No comments:
Post a Comment